π”π§π¨π«π πšπ§π’π³πžπ 𝐎𝐫𝐠𝐚𝐧𝐒𝐳𝐞𝐝

Bolutife Oluwadele
2 min readNov 14, 2024

--

α»ŒΜ€kanlọmọ of Lasgidi

Paro lo baba mi

Omoh, you still dey street o

Go on soun, no shaking Doki Oloye

You sure say you no miss road so

Road to Alagbado abi wia?

No, na road to Bonsue Fuji Chamber

Wahala don sew agbada for you

I bin tink say na kaftan e sew o

Wetin dey sup my guy

We dey wia we dey o

Urgent 2k dey ground?

Ojigbijigbi, Shege Jagua

Let us be serious fah.

Na im make I talk say you miss road

I nor come understand you again o

If to say you don gather koret kusa now

I for follow you japa nau

You for don buy danfo since

I nor wan be transporter nau

Beht you fit take am enter koret place nau

Shey nor be wetin I bin dey tink sha

As per membership of NURTW

Henni persin yarn you say you no well?

Nothing do me o

I dey go book you for Yaba Left nau nau

Dem fit make you treasurer dia fah

E be laik say you dey serious dis taim

You saw wetin I am β€˜sawing’ nau

You don join Zebrudaya Club also

Na persin for dey paro for you

And twuale per second per second

And if the uncrowned king of Oshodi laik you

Lobatan, laif don set finish.

You nefa see Punch report

About the kin kusa dem make

Up National, no shaking

Two hands, tiri gbosas for one persin

Ko soba Loshodi nau

Ayafi Oluomo worldwide

Governor-General among the nations

Up National wey nor get rival

Honestly, there is a need to study

His managerial acumen

But our egoistical mien

Will insist he is not lettered

Hinsaid dis economy fah

Commanding such huge amounts

By a supposed outliner

Of the Organized Private Sector

And the Governors Forum

Like β€œeveryone come inside” Forum

Of blessed memory

Still going cap in hands

Soliciting for monthly allocation

That we cannot see the effect

On the people they govern.

Yet flexing muscle wey no dey

The Banks are smiling greedily

MTN is shedding crocodile tears

Cadbury sweating hinsaid harmattan

And Up National doing β€œPoint and Kill.”

For peppersoup joint

With loose belts for over-enjoyment.

What do you now think?

You sure say e nefa late so

To buy Danfo or what?

To join Up National nau

Have they become organized?

Who is better organized than them

Harnessing resources, we thought

Was in short supply.

Sure, it is time to have a rethink

And develop models of governance

From those we once derided

As illiterates.

Β©TheVillageBoy.

--

--

Bolutife Oluwadele
Bolutife Oluwadele

Written by Bolutife Oluwadele

Author of β€œThoughts Of A Village Boy”|| Chartered Accountant|| Public Policy Enthusiast & Scholar || Business Consultant|| Columnist @premiumtimes ||MAN U FAN

No responses yet