ππ§π¨π«π ππ§π’π³ππ ππ«π ππ§π’π³ππ
α»Μkanlα»mα» of Lasgidi
Paro lo baba mi
Omoh, you still dey street o
Go on soun, no shaking Doki Oloye
You sure say you no miss road so
Road to Alagbado abi wia?
No, na road to Bonsue Fuji Chamber
Wahala don sew agbada for you
I bin tink say na kaftan e sew o
Wetin dey sup my guy
We dey wia we dey o
Urgent 2k dey ground?
Ojigbijigbi, Shege Jagua
Let us be serious fah.
Na im make I talk say you miss road
I nor come understand you again o
If to say you don gather koret kusa now
I for follow you japa nau
You for don buy danfo since
I nor wan be transporter nau
Beht you fit take am enter koret place nau
Shey nor be wetin I bin dey tink sha
As per membership of NURTW
Henni persin yarn you say you no well?
Nothing do me o
I dey go book you for Yaba Left nau nau
Dem fit make you treasurer dia fah
E be laik say you dey serious dis taim
You saw wetin I am βsawingβ nau
You don join Zebrudaya Club also
Na persin for dey paro for you
And twuale per second per second
And if the uncrowned king of Oshodi laik you
Lobatan, laif don set finish.
You nefa see Punch report
About the kin kusa dem make
Up National, no shaking
Two hands, tiri gbosas for one persin
Ko soba Loshodi nau
Ayafi Oluomo worldwide
Governor-General among the nations
Up National wey nor get rival
Honestly, there is a need to study
His managerial acumen
But our egoistical mien
Will insist he is not lettered
Hinsaid dis economy fah
Commanding such huge amounts
By a supposed outliner
Of the Organized Private Sector
And the Governors Forum
Like βeveryone come insideβ Forum
Of blessed memory
Still going cap in hands
Soliciting for monthly allocation
That we cannot see the effect
On the people they govern.
Yet flexing muscle wey no dey
The Banks are smiling greedily
MTN is shedding crocodile tears
Cadbury sweating hinsaid harmattan
And Up National doing βPoint and Kill.β
For peppersoup joint
With loose belts for over-enjoyment.
What do you now think?
You sure say e nefa late so
To buy Danfo or what?
To join Up National nau
Have they become organized?
Who is better organized than them
Harnessing resources, we thought
Was in short supply.
Sure, it is time to have a rethink
And develop models of governance
From those we once derided
As illiterates.
Β©TheVillageBoy.